Image copyright
Twitter

Image example

Many Twitter NG users dey use Cynthia Morgan Instagram Live compare wen di 29 year old singer bin dey hot.

Many Nigerians waka enta social media on Sunday to tok about musician, Cynthia Morgan afta one Instagram live she do – reveal why her music career no too solid again.

Di 29 year old Nigerian raggea dance-hall singer explain say na afta she accept one contract from her former record label – North Side Music Ltd – oga Jude Okoye, wey be music producer.

Ms Morgan say she no read di contract terms before she sign am and e affect her career well-well as she lost her stage name, Instagram account, royalty and VEVO account.

Corona or no corona, BBNaija wan return – See how you fit sidon for your house do audition for Nigeria biggest reality TV show
Dem wan use ‘fake naked foto’ blackmail me – Tacha

But Jude Okoye neva come out to reply all di claims wey she make for di Instagram live, but on Sunday e tell Tunde Ednut for separate Instagram live say all di allegations wey Cynthia Morgan put for im head no be true.

However, wetin she tok don cause plenty gbas-gbos for social media and oda pipo wey dia music career don enta gear one afta dem get yawa wit Jude Okoye or dia managers don also come out to tok dia own tori.

Image copyright
Cynthia Morgan

Image example

Madrina (Cynthia Morgan) change her name for September 2017 but di tori and for pipo because of di new song wey she release for May 2018.

Bye-bye Cynthia Morgan, welcome Madrina
Blackface don dey chop money from African Queen for 10 years – 2face Management
Odas e happun to

No be only Cynthia Morgan go get kwanta wit her manager, we sabi like four pipo wey get swey don bounce and odas still dey try find dia leg for di industry.

Madrina (Cynthia Morgan) change her name for September 2017 but di tori and for pipo because of di new song wey she release for May 2018.

Peter and Paul Okoye

Peter Okoye shook mouth for di mata, e say three years ago wen im decide to comot for Jude Okoye record label no be because of fame, money or power but na because of im freedom.

Skip Twitter post by @PeterPsquare

My dear C Morgan, The decision i made 3yrs ago was never about the fame,money or power! It was for my FREEDOM!💪🏾
Sad you rejected the contract i gave u. Just because they made you see me like the bad egg. I pray you understand that God has a purpose for everything. Never give up

— Peter Okoye MrP (@PeterPsquare) May 24, 2020

End of Twitter post by @PeterPsquare

May D

May D wey react to wetin Cynthia Morgan tok, claim say im no gain anytin wen im too bin dey under di record label.

Di Nigerian singer, song writer and dancer wey real name na Akinmayokun Awodunmila carri di complain enta Twitter.

Skip Twitter post 2 by @MisterMayD

For your information I was staying in their boys squatters with their driver and their cook just one room all of us shared a toilet and I had big songs and also the other side of their twin duplex was empty! Now! I slept on brand new television carton used my shirt as cover cloth

— May D (LEGEND) (@MisterMayD) May 24, 2020

End of Twitter post 2 by @MisterMayD

Skip Twitter post 3 by @MisterMayD

How can you say greed when I never billed them for anything I have ever done for them in my life! From writing credit and vocal credit on the invasion album … ask them if I was ever greedy! Just let them say it! https://t.co/fKVkGFUbSq

— May D (LEGEND) (@MisterMayD) May 24, 2020

End of Twitter post 3 by @MisterMayD

Kizz Daniel

Kizz Daniel bin get issues wit im manager Tumi Lawrence and im fire am. But wetin make am get issues wit im manager no dey clear. But tori be say di singer and im manager bin get issues. before dem pat ways.

Brymo

Di singer wey bin dey under di Chocolate City Record lable bin get kwanta wit im managers Di singer and song writer wey real name na Olawale Ashimi also port from Chocolate city afta dem get issues like dis Cyntia Morgan mata.

2Baba AKA 2Face Idibia

Popular Nigerians singer 2Baba wey real name Innocent Idibia bin get issues wit im former label KENNIS Music before im come port to im own Hypertek label. Altho e no dey clear di nature of wetin dia disagreement be. Na afta im port from Kennis Music na im e change im name from 2Face to 2Baba.

Dem no support media player for your device

“Sometimes e good to just dey observe” – 2BabaHow social media react for Cynthia Morgan AKA Mandrina

Singer Davido also shook mouth for di mata for twitter say im get anthem for her, say make she call am.

Former Big Brother Naija star, Tacha say di mata tire her and she sorry for Ms Morgan

Skip Twitter post by @Symply_Tacha

Firstly let me start off by saying that I’m currently in a state of SULLEN💔
Few years ago CYNTHIA MORGAN was UNSTOPPABLE her ART was UNIQUE🔥
Personally I first fell in love with “Don’t Break My Heart” back then in school, my 200lvl to be more precise.

— TACHA🔱🇳🇬🇬🇭 (@Symply_Tacha) May 24, 2020

End of Twitter post by @Symply_Tacha

One popular Nigerian radio pesin Tolu Oniru AKA Toolz also react as she indict her friends say na hand wey get oil pipo dey follow leak no be hand wey get blood.

Skip Twitter post by @toolzbabe

When things were rosy for Cynthia Morgan, a lot of her celebrity frnds would always be seen around her but when things went bad, they forgot abt her& didn’t give her a helping hand.This should teach us a lesson about life, she needs all the help she can get,to get her on her feet

— Dr Toolz (@toolzbabe) May 23, 2020

End of Twitter post by @toolzbabe

Popular comedian, TV Host and actor AY don ready to support Cynthia

Skip Twitter post by @AYCOMEDIAN

Cynthia Morgan will be live on the program “UPFRONT WITH SANDRA” a mental health and well being program trageted at real people surviving real issues hosted by msvanila7.
Join us there by 8pm.
Venue: msvanila7 IG… https://t.co/J7JdUFL71L

— AY COMEDIAN (@AYCOMEDIAN) May 22, 2020

End of Twitter post by @AYCOMEDIAN

Source